... e Dey tire me because I fit get very small thing wey I for talk but I go just feel like say, e no go make since to reply person wey write very long post with may be a small straight to the point reply for that kind reply.
All u need to do na to quote dat relevant part wey u wan respond to and den make it short response to am. Nor take bc persin write long thing com make urself begin write long and senseless posts.
I Dey see some other writings wey people dey reply to say some times, e be like say dem dey cut am comot, and I go like know if I fit still do some corrections and also edit person writing if u wan reply the person?
No, u nor go fit edit person comment inside dem post. But u fit cut am or shorten am to d size wey u want. If u feel any need to edit dem comment, wetin u go do na to copy am and put for post wey u wan make and correct am if na grammar error. But if na to correct d persin based on difference in opinions, all u need to do na to share ur own perspective on dat by making ur own post straight up in response.
And I go like if person fit show me how to do am or any post wey fit lead me to how to do am or if e get any step to step guideline.
Dis na simple matter. Anything wey u wan learn or imitate for dis forum, just try and act like u dey quote d persin wey u see do am. Immediately u quote d person, u go see am for d writing space how dem take do am.