Bitcoin Forum
January 05, 2026, 12:53:35 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 30.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: The reasons why Nigerian youths dey jakpa ( travelling outside the country).  (Read 38 times)
Jubilee58 (OP)
Member
**
Offline Offline

Activity: 140
Merit: 20


View Profile
December 26, 2025, 06:54:23 PM
 #1

Di thin wey me i de yan be sey, before we bin de enjoy dis our naija, that time thins just de ok for di country Naija. Food deh, peace deh, any small money wey you hold for hand de useful. When di country de good our young youths no de struggle to jakpa from naija bcos every omah dey de enjoy di country. But di recent leaders dem wey we de produce now, don show us shegeh as every thin don turn upside down. Chai e no easy, even some people don even decide sey if na surfer e better make dem surfer out naija than to face dis kind hardship wey de for naija.

I no blame our youths, but na di government wey me i blame, because if di leaders de do well, our naija youths for no dey gridai to travel outside naija. You try finish school, no job. You try see job, no beta salary and dem go owe you for six months, only dem wey de for position go de recommend dia pikin dem to beta work. Honestly, youths de try to survive for this naija.

Abeg, no matter wetin we de face for naija, make we still take am easy and de careful for di kind decision wey we go make because i believe sey after rain, sun go shine and wetin get beginning go get end.

We dey like di Isrealites wey de for Egypt for pharaoh hand and one day, we go enter Canan land where good people go lead us .

▀███▄  S  h  o  c  k      ⚡      POWER UP YOUR PLAY!  ▄███▀
>>   Instant Rakeback  |  Weekly and Monthly Rewards  |  Original Games   <<
▀████░░░░░░░░░░░░ PLAY NOW ░░░░░░░░░░░░░░████▀
Kelward
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 994
Merit: 521



View Profile
January 01, 2026, 09:38:45 PM
 #2

Back in the days like in the 60s 70s and even in the early 80s I know say na book our naija people de go read for abroad because di country economy de stable dat time, some of dem go read book finish and come back to get better jobs for here. But unfortunately dat era don pass, our people de travel abroad now to go hustle, live better lifestyles and get well paid for any work wey dem find for abroad. Di level of work and effort wey you go put for Nigeria, if you put di same energy for abroad you go get better pay. We de see testimonies of men and women wey don japa say dem de do big things for Nigeria, wey dem no reach to do when dem still de do for here.

If you get chance to japa to get a better life abroad make you no hesitate because dis country de fall hand for ordinary Nigerians wey no get hope to get rich for here. But if you want to japa make sure say na genuine source you go follow because a lot of scam agents plenty wey de scam victims wey want to travel abroad.

 
█▄
R


▀▀██████▄▄
████████████████
▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄██████▀▀
LLBIT▀█ 
  TH#1 SOLANA CASINO  
████████████▄
▀▀██████▀▀███
██▄▄▀▀▄▄████
████████████
██████████
███▀████████
▄▄█████████
████████████
████████████
████████████
████████████
█████████████
████████████▀
████████████▄
▀▀▀▀▀▀▀██████
████████████
███████████
██▄█████████
████▄███████
████████████
█░▀▀████████
▀▀██████████
█████▄█████
████▀▄▀████
▄▄▄▄▄▄▄██████
████████████▀
........5,000+........
GAMES
 
......INSTANT......
WITHDRAWALS
..........HUGE..........
REWARDS
 
............VIP............
PROGRAM
 .
   PLAY NOW    
DBTC-brain
Newbie
*
Offline Offline

Activity: 12
Merit: 0


View Profile
January 02, 2026, 10:02:12 PM
 #3

 Na why e good make as you dey go school make you also  dey learn one or two skills. I know youths for this country  wey be say dem don graduate but dem nor wan gree work for private or government sector self. Dem dey use the skill wey dem learn take dey collect bastard money every single day. In fact self , the money wey their skills dey give pass the monthly salary wey dem go recieve from private sector.

   E get some kind skills wey you go learn like the ehn na work go dey find you. Nor be you go dey beg government for work self. Some Skills wey be say e dey in high demand and very scare dey pay pass government salary.
The world right now dey in high demand of digital skills. Skills like cybersecurity , networking, digital marketing, website Design and development, prompt engineering, graphics designing and the likes. Skills wey dey pay in dollars . How many of our youths really get all these digital skills? Only few of them. Dem think say everything na abroad e dey. If 75% of the youths really put efforts to learn these skills , you fit say the country go dey as e dey?

   Most of the youths sef wey  dey travel go abroad , some nor even get handwork dem just dey go with just certificate. At the end of the day na cleaner work dem dey go do for there. Some self na prostitution while some na Yahoo yahoo dem dey go there. Nowadays only your certificate nor go fit give you the kind work wey you dey find. Most especially when you just write to pass examination. No self study, no research , nothing nothing , you just graduate with flying certificate. How company wan take employ you when you nor dey reliable to their services?

    In my own opinion , work plenty for the country , na better skills some of our youths really dey lack. And also some of our youths nor too really dey put head for book again. Dem dey see school like just graduate and get employed something. Dem nor dey really put head down for wetin teacher dey teach . Dem want fast money fast cars. Na why some of dem dey look for greener pastures.
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!